My brothers & sisters,Spotted this on Naijarules.com :)
Make una follow me see the thing wey I thief for internet!!
The Lord's Prayer
=============
1. The Lord na mai shepherd, I dey kampke
2. He make mi sidon for where betta dey
flow and come put me next to stream make
mai bodi Thermacool.
3. He panel beat mai soul come spray am
white, come dey lead me dey go through
express road of righteousness for sake
of Hin name.
4. Walahi!, if I waka pass where arm
robber, 419 and juju people borku,
come even join okada reach valley of
the shadow of death sef, mai bodi dey
inside cloth. Your rod and staff nko?
Na so dem dey back like bone dey
comfort me.
5. You don prepare Banga and starch make
I chop. All mai enemies dey look
anyaya.
You rub me for head wit Vaseline
Intensive Lotion.
Mai cup na Ogunpa river wey come
overflow hin bank.
6. True true, betta life and mercy go gum
mai back till I quench. And man go
tanda for God house sotey sotey from
Lai lai to lai lai.
GOD ALMIGHTY, NA YOU BIKO.
AMIN!
Monday, 31 October 2011
The Lord's prayer - Nigerian pidgin style
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment